1 of 3,791

Rivers State local government election results: APC win 20 out of 23 local government


A man voting during the Rivers State local government election

Di All Progressives Congress (APC) don win 20 out of di 23 local govment areas for di state LG poll wey happun on Saturday 30 August.

Ruling party for di state wey be di Peoples Democratic Party (PDP), win just three local govment areas, wey be Port Harcourt, Obio Akpor and Ogba/Egbema/Ndoni.

Dis na di first time in di history of Rivers State since 1999, di APC go dey win 20 out of di 23 LGAs of di state.

Chairman RSIEC Dr. Michael Odey announce di winners of di LG election for di commission headquarters for Port Harcourt.

Di APC also win di councillorship election for 20 of di 23 LGAs while di PDP win di same LGAs for di councillorship poll.

RSIEC Chairman Dr. Odey say dem go present certificate of return to all di winners on Monday 1 September.

Di elections see a veri low turn out of voters as many Rivers State residents boycott di election.

But di election na signal say di state of emergency wey dey declared for di state go dey lifted at di expiration of di six months wey President Tinubu bin give wen e declare am on 18 March 2025.

Dis indication dey come as former Rivers State govnor and Minister of Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike publicly announce say di suspended Rivers State Govnor, Siminalayi Fubara, and di state House of Assembly go dey reinstated on September 18, 2025.

Wike, wey dey di centre of di political crisis, make di declaration wen e cast im vote for di local govment elections on Saturday 30 August.

Wike say di move na a crucial step to “stabilise di grassroots level.” E praise President Tinubu for making sure say di local govment elections dey conducted, as e dey vital to prevent leadership vacuum.

“If di election no dey conducted, e mean say funds no go come from di federation account to local govment councils,” Wike tok.

Di minister add say as di state of emergency dey set to dey lifted, di reinstatement of di govnor and di state Assembly go complete di restoration of governance for di state.

Breakdown of di winners

CHAIRMAN Elect: Ofori Owolabi

Vice Chairman Elect: Abunu Victoria

Chairman elect: Solomon Achoma

Vice Chairman elect: Florence Ndukwu

Chairman Elect: Eugene Ebele Cheta

Vice Chairman elect: Josephine Uba

Chairman Elect: Bob Fubarab A.

Vice Chairman elect: Wariagbani George

Chairman Elect: Otuo Loveday Promise

Vice Chairman elect: Ezekiel Raphael Abigbani

Chairman Elect: George Onengiyeofori

Vice Chairman elect: Deborah Amos Bobmanuel

Chairman Elect: Pepple Abinye Blessing

Vice Chairman elect: Ibimieye Alagbari

Chairman Elect: Michael George Williams

Vice Chairman elect: Harry Maureen

Chairman Elect: Obarilomate Ollor

Vice Chairman elect: Beauty Eke

Chairman Elect: Lloyd Chidi Julius

Vice Chairman Elect: Amadi Lilian Obiageri

Chairman Elect: Njoku Boniface Chima

Vice Chairman elect: Obele Faith

Chairman elect: Deborah Confidence

Vice Chairman Elect: Kpobari Epsibari

Chairman Elect: Wobodo Charles

Vice chairman elect: Kinika Ethel Chidi

Chairman elect: Thomas Bariere

Vice chairman elect: Ngbere Mpigi

Chairman elect: Dr. Gift Onyinye Wodo

Vice chairman elect: Dr. Mrs. Gloria Joyce Nyeche

Chairman Elect: Chukwu Shedrach Ogbodo

Vice Chairman elect: Dr. Happiness Nwokocha

Chairman elect: Vincent Nimieboka

Vice chairman: Alabo Eunice

Chairman Elect: Akuro Alfred Tobin

Vice Chaiman elect: Obulubo Charity

Chairman Elect: Obasi Uchechukwu

Vice Chairman elect: Achiri Faustina Joy

Chairman Elect: James A. James

Vice Chairman elect: Jacks Gladys

Chairman elect: Okechukwu Akarao Nwogu

Vice Chairman elect: Okorie Ngozi Juliana

Chairman elect: Sir Allwell Ihunda

Vice chairman elect: Tom Quinn Mina Mildred

Chairman elect: Okwe Mbakpone

Vice Chairman elect: Caroline Amawa

‘Di LG election dey peaceful’

Rivers State sole administrator speaking to the press

Wia dis foto come from, RSGH Media

Rivers State Administrator, Vice Admiral (Rtd) Ibok-Ete Ekwe Ibas, say e dey satisfied with di peaceful and orderly conduct of Saturday local govment elections, as e dey signal a decisive and positive step toward restoring full democratic governance for di grassroots level.

Vice Admiral Ibas, wey bin monitor di electoral process across several local govment areas, say e dey encouraged by di conduct of voters and election officials, wey create calm and secure atmosphere for di exercise.

Di Sole Administrator monitoring tour include stops at di Emohua Council Secretariat, di Okporowo/Ogbakiri community, Igbu Ogbo village for Ahoada East, and Ogbunuabali Town for Port Harcourt City Local Govment Area, wia e observe proceedings and interact with citizens.

“I dey veri happy wit wetin I don witness today. Di process dey notably peaceful, from di significant turnout to di orderly conduct of both voters and election officials. I dey confident say at di end of di day, we go get credible set of results wey we all go dey proud of as a state.

“Generally, di situation dey calm and seamless across di state. We never receive any major negative reports, wey be testament to di collective desire for peace and normalcy,” e add.

Emphasising di significance of di election, Vice Admiral Ibas stress say di pipo of Rivers State don show dia desire to elect legitimate leadership wey dem go fit identify wit at di local govment level, and add say di successful poll dey in direct alignment wit di primary objective of im mandate to stabilise di state and return am to democracy.



Read More

Leave a comment